Even though many pipo don dey reason say INEC fit announce say dem don move di election date go front sake of di naira scarcity challenge wey bin confront di kontri. Anoda tin wey Nwagwu also tok about be say di new electoral reforms and di use of technology help di electoral join bodi to fit achieve di presidential election date delivery. E say di new electoral reform give chance to improve di electoral process. Oda times wey INEC don postpone major electionsFor 2011, voting bin don actually start for some parts of di kontri wen INEC announce say dem don move election by two days. Also for 2019, di Inec announce say dem don postpone election less dan 10 hours to di time wey voting go start
Continue reading...